Ogbeni make you use your head oh
I know say for the street e dey red oh
Twenty four seven we dey grind for the bread oh
The kind of race wey we dey run no dey end oh
Shebi na my mate wey dey drive benz
Shey na my mate wey dey build house
Shebi na my mate wey dey fly first class
Shey na my mate marry better wife
I no dey sleep every night
I no dey sleep every night oh
Me i want to make mama proud
And i want to make papa proud oh
Every night we dey hustle
I say we no dey thief, my guy you gats believe say
Na hustle we hustle
And if olopa wan come our way, we go tell dem say
Na hustle we hustle
From the street we don go far away, shey you know say
Na hustle we hustle
We no dey look uche face oh
We wan count our pounds and dollars
Eh Check And Balance
We dey pray make Oluwa answer
Money for the bag e dey hala eh
Say the account balace
Get sense, get sense
When the money come if you like take am buy benz
But make you no forget say suffer dey sha
Carry olosho, that one dey sha
Your men dey para say dem never chop
You sef wey don collect block why you come dey lock up
Na person wey no know person dey help person
Who carry money go market na him dey buy something
Every night we dey hustle
I say we no dey thief, my guy you gats believe say
Na hustle we hustle
And if olopa wan come our way, we go tell dem say
Na hustle we hustle
From the street we don go far away, shey you know say
Na hustle we hustle
We no dey look uche face oh
We wan count our pounds and dollars
Eh! Check And Balance
We dey pray make Oluwa answer
Money for the bag e dey hala eh
Say the account balace
I no dey sleep every night
I no dey sleep every night oh
Me i want to make mama proud
And i want to make papa proud oh
I no dey sleep every night
I no dey sleep every night oh
Altrayd with the vibe oh-oh
Eh-eh