Jangin'
Moni Jimi Jimi Jangin'
The way you, chop my eye and you match my face
Dey make me feel like say guy man dey craze
The way you fall my hand for the setting wey we dey
I just dey shine my teeth like say na play play
Say girl you wash me die, girl you wash me tire
Say I no get Power I no get Empire
If I clear you dem go call me agbaya
All my enemies die by fire
Uju, let's have a secret agenda
Make I follow you like bumper to bumper
Aproko must to talk our matter
We be giving dem back to the sender
Oya back to the matter wey dey ginger o
I wan shoot shot make I call Clarence Peters
Sun momi no need to dey malinger
Love tori wey dey burst my medulla
Obianuju
I for don leave you long time ago, if no be say I love you
Obiageli
Calm down I go make this money, because of iPhone you don dey call chief honey
You be first class heartbreaker
Omotena I dey look you from afar
I enter your p and you say na based on kpa
You come ask me where I park my car
I drive Legedes Benz I no be big baba
You come dey, wash me die like a Bentley tire
Na that time I know say I don suffer
You chop my eye like say na hamburger
Last last you go follow my brother
No be you wey I see for The Place
When you go chop life with brother Ikenna
Wey I don see say you dey in love
You come leave me go my black Cinderella
You no try, you no try for me
As you don fall my hand omo na die for me
Which baby go dey knot my tie for me
All my guys and my girls sef dey cry for me say
Obianuju
I for don leave you long time ago, if no be say I love you
Obiageli
Calm down I go make this money, because of iPhone you don dey call chief honey
You be first class heartbreaker
Obianuju
I for don leave you long time ago, if no be say I love you
Obiageli
Calm down I go make this money, because of iPhone you don dey call chief honey
You be first class heartbreaker
Obianuju
I for don leave you long time ago, if no be say I love you
Obiageli
Calm down calm down
Obiageli
Calm down calm down
Uju, long time I don dey on your matter
Because of assurance you do me kayanmata
As you come see say no be me be Dantata
You come run away chop my eye patapata
Sho fe sh'ogun si Shina Peller
Iwo gaangan ni damboroba
Calm down calm down